Who we be · About Us

PidginEduCreativeHub

Learn, Laff, Grow – De Pidgin Way!

Pidgin Edu Creative Hub – Where Learning Meet Enjoyment!

Our story

Who We Be

Pidgin Edu Hub na de ogbonge online platform wey dey teach people for Pidgin English, use skits take entertain dem, and do writing competition wey go make dem show wetin dey dia bodi. Di platform go help Pidgin totori people for West Africa and oda places wey dem dey talk Pidgin, make dem learn beta tins wey go help dia life.

Di mata go cover handwork, business sense, and how to manage moni well well. Our plan na free content and pay chenkele moni wey people go fit afford, plus support from adverts and joinbodi wey go help di platform grow.

We dey mix education, entertainment, and wetin dey bodi to give people beta learning opportunities. Our skits and competitions go make learning sweet, and di platform go help many people repair dia life.

Pidgin Edu Hub no be only place to learn business or skills; na beta platform to move the Gospel of Baba Godey — Jesu Christi — for simple Pidgin English wey everybodi fit understand. We wan reach people wit the message of hope, love, and salvation.

Why We Teach for Pidgin

For our teacha journey, we don sabi say language get big mata for how we dey show our thinking and ideas. To pass message no be about one particular language; na whether person understand am and fit use am do beta tin na im mata pass.

Many tins wey dem dey do for China and America, dem dey explain am for Chinese or English, but e no stop am from making sense anywia. Na why we choose our local Pidgin English to break tins down, so our learners go understand am well well.

Our purpose

Wia We Dey Go

01

Mission Statement

Na to make education easy and fun for Pidgin totori people, so dem go fit learn new things wey go help dem for life.

02

Vision Statement

Na to make Pidgin Edu Hub di numba one ogbonge platform for learning and wetin dey bodi for all Pidgin totori people for Afrika and for Oyibo Contri.

Core values

Wetin We Value Pass

01

Education na for Everybodi

We believe say learning suppose easy and make sense for all man, no mata whia dem come from or how dem school reach.

02

Pidgin Na We Own

We dey carry Pidgin for head because na language wey fit help us share sabiness wey go make sense for everybodi.

03

Beta Learning wit Enjoyment

Learning dey sweet when e follow beta gist, skits, and wetin you get for bodi. We dey mix education wit entertainment.

04

Make Life Beta

We wan give people correct skills and sabiness wey go help dem move dia hustle, grow dia business, and beta dia life.

05

One Ogbonge Pidgin Cominiti

We dey gather one big family of Pidgin speakers wey go reason together, share ideas, and help each other grow.

06

We Sabi Do New Tins

We dey always find new, fresh, and correct ways to make learning easy, interesting, and useful for our people.

07

Correct and Tru Tru Somtin

We no dey give lai lai or sabiness wey never cook done. Everything wey we teach suppose be original, correct, and useful.

08

Everybodi Dey Inside

No mata who you be or wia you from, you fit learn with us. We no dey show partiality; na for all man.

09

Learning E No Dey Finish

Person suppose dey learn new tins every time. We go keep sabiness gidigba so all man fit grow.

10

We Wan See People Grow

Our own no be just to teach. We wan see people and communities grow, make life beta, and create change wey go last.

Why Choose Pidgin Edu Creative Hub?

Na Your Language, Na Your Learning

We teach for Pidgin English, so e go easy for you to sabi and enjoy. No grammar wahala!

Education Wey Sabi

We no just dey talk. We dey give real sabiness wey go help your business, hustle, and everyday life.

You Go Learn wit Enjoyment

Learning fit taya person, so we mix am wit skits, beta gist, and sense to make am sweet.

Korokoro Skills for Real Life

Business sense, handwork, and moni management — tins wey you fit use sharp sharp.

Na For Everybodi

Whether you don go school or you never go, you fit learn and grow with us.

Win Prizes & Make Dem Know You

Writing competitions and creative challenges give talent chance to shine. Check each challenge for confirmed rules and rewards.

Join Beta Cominiti

You no go learn alone. Meet people wey reason like you, share sense, and help one another.

Affordable Learning

Our aim na small subscriptions and awoof content so everybodi fit benefit.

Anytime, Anywhere

Wit your phone and internet, you fit learn at your own time, without stress.

Make Sense & Grow

We wan help you make tomorrow beta, grow your hustle, and become beta contri person.

Who Go Fit Benefit?

01

Young People · 18–35

Pidgin speakers wey wan learn beta tins, start a hustle, and show wetin dey dia bodi.

02

Mama Dem & Papa Dem

Parents wey wan learn work, grow business, or express dia talents.

03

Small Business Ogas & Everyday Learners

Including people wey no get beta chance to go school — for Nigeria, Ghana, Sierra Leone, Cameroon, and Obodo Oyibo.

Why We Dey Different from Odas?

We Dey Teach wit Pidgin English

No grammar wahala! We break lessons down jeje for Pidgin wey people fit sabi. Learning no suppose depend on whether person fit follow big English.

Learning + Entertainment = No Dull Moment

No be only bookwork. Skits, gist, true-life examples, laff-laff people, and storytellers make learning joli joli.

Practical Knowledge Wey You Fit Use Sharp Sharp

From business and moni mata to handwork and bodi mata, every lesson na to help you grow for real life.

Writing Competitions & Challenges

Show your talent for Pidgin writing, skits, and storytelling. Each competition go state its own prizes, features, and course rewards.

Cheap & Accessible for Everybodi

We aim for affordable subscriptions and free content. Your phone and internet fit bring learning to you anytime, anywhere.

Strong Community of Pidgin Speakers

We dey build one big family to share ideas, support each other, and grow together through forums and mentorship.

Local Content, Global Impact

Our lessons focus on real-life issues for West Africa and beyond, with African examples and culture wey our people understand.

Pidgin Edu Hub no be just another e-learning platform — na movement to educate, entertain, and empower Pidgin talk-talk people. We stand for de gap between beta education and street wisdom.

Our Team

01

Creative Team

Skit producers, writers, and competition judges.

02

Technical Team

Developers and platform maintenance.

03

Customer Support

Help for learners and competition participants wit technical and content-related matas.

04

Marketing Team

Social media and campaign strategists.

Together, we dey make learning, entertainment, and creativity work for our people.

Our voice

Pidgin Edu Hub Anthem

Verse 1

We dey learn, we dey grow, we no go stop,Pidgin na our power, we go reach the top.With gist and knowledge, we go shine,Education sweet when e blend with rhyme.

Chorus

Pidgin Edu Hub, na we way,We go learn, we go play.Hustle strong, future bright,With wisdom, we go shine our light!

Verse 2

From street to school, from dream to plan,We go use our sense, we go make am stand.Na who sabi, na him go win,We go rise, no matter where we bin!

Find us

Come see us.

Street A16 No 5, Kuchiyako Extension, Kuje, Abuja.

Reach out anytime

Whether you wan learn a skill, teach one, or partner with us — we dey here, and we go love hear from you.

Ready when you ready

YourNextChapterStartsHere.

Free to start. No long talk. Pick a course, join the community, and begin today.